Love no be for the weak

in #hive-14008412 days ago

Make I tell una one story 'bout one man wey name be Kachi . Kachi na be the definition of a good man, but him get one wife wey name be Ama, wey be very very wicked wary person.

Ama no dey cook for Kachi, Ama no dey sweep house, Ama no dey do anything wey go make Kachi happy. But , him dey work hard, dey bring money come give Ama, thinking say Ama go change.

But Ama no change, she just dey spend Kachi money any how shekke , dey go party with her friends, dey leave Kachi suffer, plus she dey torture am with Koji too.

One day, Kachi come back from work, him see say Ama don sell him TV, him phone, him laptop, everything! Kachi ask Ama say "Ama, wetin you do with my things?" Ama say "I sell am, I use the money buy clothes and makeup".

Kachi shock, him no know wetin to do. Him tell Ama say "Ama, I dey tired, I no fit take am again". Ama say "Okay, if you no fit take am, then commot for my house!"

The nigga stroll commot the house , go rent one small apartment , come start to dey stay there. But him never forget Ama, him still dey love Ama, him dey hope say Ama go change one day.

But Ama no change, her just dey move from one man to another, dey cause trouble everywhere her go.

Kachi learn him lesson, him know say him no fit force love, him move on with him life, him find another woman wey love am truly.

Moral of the story be say, no matter how much you love person, if dem no love you back, no force am, move on with your life.

Sort:  


Please vote for Ecency proposal👇
https://ecency.com/proposals?filter=team

Congratulations @rankz! You have completed the following achievement on the Hive blockchain And have been rewarded with New badge(s)

You published more than 100 posts.
Your next target is to reach 150 posts.

You can view your badges on your board and compare yourself to others in the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Check out our last posts:

The countdown to HiveFest⁹ is one week away - Join us and get your exclusive badge!
Our Hive Power Delegations to the August PUM Winners
Feedback from the September Hive Power Up Day