Ewo, it was fire o. Demba Ba, Demba Ba, wan do person strong thing o. Wenger nearly piss for trouser!
Na nil all draw for Turkey st leg.
Fenerbache con dey boast say dey go play us for home. We jus dey laff dem.
True, true o, see Fener o. They collect red card, but with their men, dem dey play like say na their stadium.
Arsenal dey lead one nil, with pressure from Fener. Demba Ba, it was the last minute, suddenly come see Demba Ba thru alone with d goalkeeper.
See, u know how many Arsenal fans them don admit for clinic?
Demba Ba shift ball, place ...Wenger nearly collapse that time. Me, I don't know.
Suddenly keeper save the ball. As keeper save ball ref blow whistled to end ge. Come see relief, no power for folks to rejoice sef, people don dey drained by d Fenerbache pressure.
When I dey tell people say, there's peace of mind now in Arsenal they nor know say I think many things.